ABI OGONI CLEAN UP TRAVEL???;Legbara Nubor Legbara

Image may contain: sky, outdoor and natureImage may contain: one or more people, people standing, fire, outdoor and nature
ABI OGONI CLEAN UP TRAVEL???
Mr. Irabor for NOSDRA, Osinbajo and Buhari da cheap liars and dribblers plus our broda Dekil for HYPREP, even $HELL and NNPC with other polluters and killers self, abi first and second, even third quarters of the year don pass; fourth dey run 4-40 like light speed, or una 4get?
Na october we wan enter so, we be say the year don almost comot or die---no, na finish be the beta word.
Ogoni clean up and pay up no dey una book again; wetin happen or no happen; the clean up and noise or more lies travel to where; pakistan or afghanistan; no na for sokoto or kwara the clean up travel? As una dey play and lie, make una know say na lies and games, torture, oppression like this one wey make peporo wan leave their countries, weda by force or no be force, to form new ones.
Nigeria don take too much from Ogoni.
Na Ogoni turn to get clean up, restore up and pay up while the peporo dey wait for their overdue state when una restructure to true fiscal federalism in regional system we be last hope for the country, if this one no be another lie to cover una government lies and bad work until dem vote una out of power soon.
Ogonis go care for themselves and their land, environment wey don die for Nigeria hand, in inside their own state or go do the same thing inside South-south region with other peporo wey dey there and get oil and gas. Na clear e be say Nigeria or Rivers state no fit and no wan care for Ogoni peporo with their land so the final and true thing be say the owners go care for themselves.
If na honest and smart peporo wey get the peporo the get under them for mind una for don use the so-called military power una get and dey threaten and kill innocent peporo solve problems and avoid wahala and crisis, even conflicts and talks to breakup with no force and government and peporo wey say dem get am for north and some other places dey want fight war with soldiers we never fight another country we get beta guns except peporo wey no get guns and never fit eat well to stop breakup.
Everything una dey do to the poor and weak get return abi na payback; make una know say Ogoni no go gree; my own don finish...
Na Ben Ikari i be o!

Comments

Popular Posts